Monday Inspirational Quotes

🇳🇬Chicken wey run away from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup; YOU CANT RUN AWAY FROM YOUR DESTINY. 🇳🇬Today's newspaper na tomorrow suya wrap; KEEP CALM NOTHING LAST FOREVER. 🇳🇬Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef; JUST BE PATIENT LET THE GAME COME TO YOU, DON'T RUSH. 🇳🇬Akara and moinmoin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different; HOW YOU START DOESN'T MATTER, WHAT MATTERS IS HOW YOU FINISH. 🇳🇬If life show you pepper, my guy make pepper soup from it; MAKE SOMETHING GOOD OUT OF A BAD EXPERIENCE. 🇳🇬I get am before no be property; STOP LIVING IN THE PAST AND START LIVING IN THE PRESENT. 🇳🇬If person too tey for party e go follow dem wash plate; DON'T OUTSTAY YOUR WELCOME. 🇳🇬Craze no hard to form na d trekking be wahala; EASIER SAID THAN DONE. 🇳🇬No matter how hot your temper be, e no fit boil beans; CALM DOWN, YOUR TEMPER WON'T SOLVE THE PROBLEM. 🇳🇬Every mallam with im own kettle, every northerner with im own radio; EVERY MAN FOR HIMSELF. 🇳🇬Frog eye no be open eye: HAVING BIG EYES DOESN'T MAKE YOU CIVILISED. 🇳🇬Bring suya...bring suya, na cow body dey suffer am; EVERY ACTION HAS A CONSEQUENCE. 🇳🇬E go better e go better na im make ibo man still dey kano; WHEN THERE IS LIFE THERE'S HOPE. 🇳🇬The difference between ipekere and plantain chips na packaging; DONT JUDGE BASED ON APPEARANCE ALONE. 🇳🇬Escort me, escort me, na so slave trade take start; SERIOUS THINGS SOMETIMES START LIKE JOKE. 🇳🇬Pikin wey use agbada take start, abeg wetin e go wear wen e old; SLOW AND STEADY WINS THE RACE. 🇳🇬The water wey dem use make eba can never be recovered back; DONT CRY OVER SPILLED MILK... #HappyNewWeek. #JahBlessOurHustle.

Comments

Popular posts from this blog

From Otan Ayegbaju to National Leadership: Celebrating Nigeria’s Youngest JAMB Registrar at 39